Skip to main content

Posts

Showing posts from July, 2018

Diary Of A Lazy Nigerian Youth : Episode 1

“ Bros, your phone don dey ring since o, I say make I kuku ma com give you since the battery don full. As a regular customer now, you no go vex if I comot your fone make I allow other pepu charge na, you know say the country hard, man pikin need all the change wey e fit pakage o”.. Guy take your time o, if my fone no full enh, I dey bring am back o, I no fit shout. That 50 card yu dey collect no be beans o. but who you say been dey call me? Any name show? Abi na just those fake MTN spam callers wey no dey allow pesin rest, na so so subscribe subscribe be dia own everi day, weda da person don chop sef nothing concern dem,na just to chop your credit be dia plan. Yeye scam pepu. “ I no get time look who dey call as I been dey barb customer dat time, as da thin com dey too plenty na em I say make I com give you. Hope say I no disturb your sleep sha? Not at all, as work no dey today make I take time rest body for house today. I cant come and die for this own o. monkey no